BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Di attack for Niamey na attempted coup but under control - Niger authorities tok
Pipo hear heavy gunshots and explosion across parts of Niger capital, Niamey early mormor on Saturday. Eyewitnesses say serious fight dey happun near Diori Hamani International Airport, di military Base 101 and di presidential palace.
Jamb give candidates deadline on admission offer
Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don extend di deadline for candidates wey dem offer admission to either accept or reject am on or bifor Wednesday, 30 September.
'Within one year we go control insurgency and insecurity for Nigeria' - Atiku Abubakar
Di veteran politician wey don always tok say e go remove fuel subsidy also tok say im dey healthy, agile and younger dan di current president of Nigeria - so im fit lead Nigerians well.
Police teargas protesters for Kenya as traders close shops to protest increase in tax
Wetin cause all dis kasala be say recently, di KRA bin increase di value wey dem give consolidated 40-foot container to 3.2 million Kenyan shillings.
Death toll rise to 389, as 910 pipo still dey miss afta heavy flash flood for Nepal
Di army tok-tok pesin say dem don rescue 50 foreign nationals, including 30 Indians, eight Chinese, eight Koreans, two Americans and two Italians. South Africa foreign ministry don confam say six of dia citizens dey among pipo wey miss afta di heavy flood wey happun for Nepal.
Nigeria Football Federation President Ibrahim Gusau don resign
President of the Nigeria Football Federation Ibrahim Gusau don resign im position as president of di federation.
EFCC say new whistleblower policy fit make pesin multi-millionaire, but how similar policies work for past?
Na President Muhammadu Buhari first introduce di whistleblower policy for 2016, so dis announcement by di EFCC na new policy abi na di same Buhari own?
Prosecutor want more prison sentence for Simon Ekpa wey dey appeal im six-year jail sentence
Simon Ekpa dey continue to deny any wrongdoing. E admit say e establish di Biafra Republic Government in Exile (BRGIE) and say na im be di prime minister of di organisation.
Trump administration pause immigrant visa appointments for applicants worldwide as US make more immigration plans
Since President Donald Trump take office, im administration don cancel more dan 175,000 visas of foreign citizens on various reasons, according to di State Department.
Special Tori
Nigerians dey face accuse of sextortion for US - Wetin be sextortion and possible jail term for offenders
Two Nigerians don land America to face prosecution on top accuse say dem dey involved in online sextortion schemes wey link to di death of one American teenager
'Register your marriage' - Why South Africa Home Affairs give couples deadline to register di marital status
South Africa Home Affairs say many couples don fail to register dia customary marriages even though dem sabi say di law dey effective.
King Harald of Norway don die at di age of 89
Di late king rule for 35 years and e break tradition as e marry commoner but e dey widely loved by Norwegians.
Nigeria kidnappers collect nearly $6 million as ransom for 2025 - Report tok
Di report tok say Boko Haram collect 90% of di entire ₦7.779 billion wey kidnapper collect as ransom, from just two mass abduction of ova 700 pipo, wey happun for Niger state and Borno in 2025.
Wetin be di new community service law wey go deal wit minor crimes for Ghana?
Ghana pass Community Service Law wey go punish offenders of petty crimes to do community work for up to six months, instead of say dem go enta prison.
67 Nigerians return from South Africa ahead of September 30 deadline for all illegal immigrants to comot
Di March and March group for South Africa dey maintain pressure for dia anti-immigration protests wit di new deadline of 30 September approaching.
How two airport workers die of malaria afta 'mosquito enta inside plane'
German public health officials believe say di outbreak na sake of mosquitoes wey enta plane take flight to di busiest airport for Germany.
Interpol arrest suspected black axe scammers, identify hundreds for cyber crimes across West Africa
Interpol say dis operation take dem eight months for different kontris wia dem also identify 263 criminal suspects.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.















































