Wetin we know as former Nigeria minister Timipre Sylva resign from APC

Published
Read am in 6 mins

Former Minister of State for Petroleum Resources, Timipre Sylva don comot from di ruling All Progressives Congress (APC).

E announce say im don resign from di party on Monday 31, August 2026 for inside letter wey e send to im APC Ward Chairman.

Oga Sylva dey resignation wit few months wey remain for di 2027 general elections to start.

For inside di letter e tok say di party don abandon di principles wey dem bin build am ontop.

For di letter di former Bayelsa State govnor, wey describe himself as one of di founding member of di political party APC say im make di decison afta e do tok-tok wir im family, associates, colleagues plus pipo wey get soft mind for wia im dey.

"Moreover, I no go fit in good conscience continue to belong to a party wia leaders beliv say 'evritin dey fair for politics' ; and dem don consistently demonstrate dat belief i practice".

Why Timipre Sylva comot from APC

Oga Sylva comot sake of say im no happy at all sake of wetin im described as di reversal of di party founding ideals.

Im tok say e dey"pain am well-well" to see di principles wey im and oda members bin use help build di party but e don change to di extent wey e don dey "so thoroughly and unrecognisably thwarted."

Im also criticise wetin im describe as di beliv say among APC leaders "evritin dey fair for politics," .

Im no agree wit dat kain way at all as im tok say e no dey okay wit am and e no match wit basic decency and morality.

"Di present Govment, formed under di banner of di APC wey we bin love bifor don disappoint di vast majority of Nigerians," Sylva tok.

Im add say from wetin im dey see, e be like say hope no dey at all to bring di party back to life.

Di former minister aslo tok say "im no get anoda choice dan to comot from ship wey be like say dem don lock all di all di load of iniquities wey dem no fit redeem."

Oga Sylva no end wit im resignation letter to im Wrad chairman, e also copy Nigeria Corruption Police di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) for di letter.

E sama accuse for dia head say dem bi agency wey dey act well-well "more like organ of di APC dan as institution of State."

"I dey fully aware say di action wey I don take fit invite double witch-hunt against me and my associates, but na di risk wey I dey willing to take," im tok.

Sylva deny accusation afta dem declare am wanted

Timipre Sylva dey face plenti gbege for Nigeria wit di current President Bola Tinubu administration.

Di former minister bin dey for di good books of former president, late Muhammadu Buhari but evritin change afta Buhari comot from office and later kpai.

President Bola Tinubu administration and Timpre Sylva dey like cat and rat , recently dem bi declare Timipre Sylva wanted sake of accuse say e follow for di pipo wey plan coup to remove oga Tinubu for office wey no work.

Reports bin dey say some officials bin raid di Abuja and Yenegoa residence of di former minister.

One of im media aide Bokoru bin confam di tori say some individuals bin raid di residence of Timipre Sylva wey dem beliv say na operatives of di Defence Headquarters for reason wey dem no know, e add say:

"During di said operation, considerable damage bin dey inflicted upon di property.

Despite sustained efforts, I neva fit ascertain di reasons or authorisation for dis raid. To di best of my knowledge, di officers involved no provide any categorical explanation for dia actions, either at di time of di raid or subsequently."

Bokoru add say Timipre Sylva and im wife, Alanyingi Sylva, bin dey outside di kontri at di time of di incident.

Former Minister of State for Petroleum Timipre Sylva deny say im bin get hand for di alleged coup plot for Nigeria.

Di tok-tok of coup for Nigeria bin dey fly evriwai but di Defence Headquarters for Nigeria bin say di tori no be true.

Dis tori bin fly upandan afta dem cancel di October 1 Independence day celebrations.

Dem bin also arrest 16 military officers wey bin dey face disciplinary panel.

Brigadier General Tukur Gusau for statement bin tok say dem dey investigate di said sixteen officers and di process dey within di military internal discipline and professionalism and di panel go make di findings public.

Timpre Sylva profile

Timipre Marlin Sylva na Nigerian politician and e don be former Minister of State for Petroleum, Former Governor of Bayelsa State and former member of di Rivers State House of Assembly.

Born on 7 July, 1964, for Brass Bayelsa State, Sylva start im political career for 1992 wen e represent Brass Constituency for di Rivers State House of Assembly for di old Rivers State. At di time, im bin be di youngest of all di members for di house of Assembly.

Im political career continue wen e become Special Assistant to di Minister of State for Petroleum in 2004 wen Edmund Daukoru bin be di minister.

E later resign to join di PDP gubernatorial primaries in 2006 for Bayelsa State wia e come second behind Goodluck Jonathan. After di PDP presidential primaries election wey Jonathan come dey appointed as a running mate to Umaru Musa Yar'Adua, di gubernatorial candidacy for PDP become vacant, and Sylva come dey elevated to occupy di position of PDP gubernatorial candidate.

As a candidate of di Peoples Democratic Party, Sylva win di 2007 Bayelsa State gubernatorial election and succeed Goodluck Jonathan wey go on to di position of Vice President.

Sylva opponent for di 2007 election, Ebitimi Amgbare of Action Congress, legally challenge im victory. Although di Bayelsa State Election Petitions Tribunal uphold Sylva election, Amgbare carry di mata to di Appeal Court for Port Harcourt wey overturn di Tribunal decision and nullify Sylva election on 15 April 2008.

Di Appeal Court five judges for dia unanimous decision give order for di Speaker Werinipre Seibarugo to dey sworn in to replace Sylva as acting govnor, and order a new election to hold within three months.

A new election hold on 24 May 2008, and Sylva, again running as di PDP candidate, come dey elected with 588,204 out of about 598,000 votes.

Dem swear am in again on 27 May, 2008 but on 27 January 2012, im tenure come dey terminated by di Supreme Court with an acting govnor appointed to oversee di state until di election of February 2012.

On Wednesday, 21 August 2019, President Buhari appoint Timpre Sylva as di Nigerian Cabinet Minister of State for Petroleum Resources.