Iran attack US targets for Middle East afta four pipo reportedly kpai for wedding celebration

Four killed in US strike on wedding ceremony

Wia dis foto come from, Iranian Red Crescent Society

Published
Read am in 2 mins

Iran don launch missile and drone attacks for US targets across di Middle East, afta American forces resume strikes against Iran.

Kuwait and Jordan say dem dey respond to Iranian attacks early on Wednesday, while Iranian state media report strikes on Iraq and Bahrain.

Dis dey comes afta di Iranian Red Crescent say four pipo including one pikin kpai for one wedding celebration wen shrapnel from one US missile hit one house for southern Iran. Iranian media initially say five pipo kpai.

In response, Mohammad Bagher Ghalibaf - Iran chief negotiator wey bin dey tok wit US earlier dis year - say: "If one power act like Satan, pick targets like Satan, and kill like Satan, na Satan".

Di US military say dem dey aware of di reports but say dem no targets civilians, and say dem dey strike Iranian targets in response to "recent attempted attacks" on American forces and commercial shipping for di Strait of Hormuz.

US urge Americans to stay vigilant for Middle East

Di US Embassy for Abu Dhabi and di US Consulate General for Dubai don warn dia pipo of "di potential for unforeseen escalation" during di rising tensions for di Middle East.

Dem don urge Americans for di region to "exercise heightened vigilance" and prepare for possible flight cancellations, airspace closures and oda travel disruptions.

Di advisory also note say US diplomatic facilities don previously dey targeted, both for di Middle East and oda places.

Dem warn say Iran and groups wey dey support Iran fit target oda US interests overseas, including businesses and institutions wey dey associated wit di US.

We dey update dis tori