Wetin we know about di 60 fresh abduction for Niger and Zamfara states

Wia dis foto come from, Getty Images
Suspected bandits don kidnap more dan 60 pipo for separate attacks for northern Nigeria.
Dis na di for di latest wave for di series of kidnappings wey armed criminal gangs don carry out dis year.
Police for Niger State, northwest Nigeria wey confam di tori, tok say suspected bandits kidnap more dan 20 pipo for Mukura village, Kasuwan-Garba district of Mariga Local Govment Area on Sunday afternoon.
Tok-tok pesin for Niger State Police Command, Abiodun Wasiu, for inside statement say di attack happun around 3:00pm on Sunday, 27 September.
E add say joint security teams don launch rescue operations to secure di victims release.
Also, for anoda separate kidnapping incident, jaguda pipo kidnap at least 47 farmers, most of dem women as dem dey harvest groundnuts for Mariga area on Saturday, according to international news agency AFP.
Anoda report also claim say at least 40 women dey kidnapped for Yargada community near Gusau for neighbouring Zamfara State on Sunday. BBC News Pidgin neva fit confam dis tori.
Kidnapping for ransom don bicom one of Nigeria most constant security challenges, particularly for parts of di northwest and north-central regions wia heavily armed gangs, wey dey locally known as bandits dey operate across vast rural areas.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di criminal groups dey frequently raid villages, rob residents, tiff animals and kidnap pipo for ransom.
For many affected communities, farmers don struggle to access dia farms becos of insecurity, and e don raise concerns about livelihoods and food production.
Despite President Bola Tinubu repeated warnings, di kidnapping mata still dey ginger.
For June, during im nationwide Democracy Day broadcast message, di Nigeria leader again send strong warnings to bandits, kidnappers and sponsors of terrorism, as e announce say dose wey continue to threaten di kontri peace and security go face di full force of di law.
E say di window for surrender and repentance no go remain open forever.
Niger State, wey dey di border of Nigeria capital Abuja, don witness plenty attacks in recent years, especially for remote communities close to forests, wey dey serve as hideouts for armed groups.
Mariga Local Govment area dey among di worst affected.
Neighbouring Zamfara State dey regarded as one of di hotspots for Nigeria banditry crisis.
Despite military offensives and security operations, kidnappings and village raids continue to happun across several local govment areas.
Authorities say security personnel dey put efforts to locate di victims and track down di pipo wey dey responsible for di latest abductions.
Why mass kidnapping dey kontinu for Nigeria and how dem fit stop am
Mass kidnapping don kontinu to happun for different parts of Nigeria, as bandits and terrorist groups dey increasingly target schools, markets and oda places wey pilo dey do dia daily activities.
Detective Auwalu Bala Durumin lya tell BBC News Pidgin say four major reasons dey behind why bandits dey carry out mass abductions.
E say lack of basic security awareness and protective skills dey make am easier for bandits to attack large numbers of people.
According to am, di first reason be say many communities dey serve as easy targets for criminals. "Na veri easy tin for bandits to come abduct pipo bicos many pipo no get wetin we dey call vital security, basic security knowledge and vital security skills to protect dia selves," e tok.
Di second reason, according to am, na wider publicity.
E explain say mass kidnapping dey attract attention and help criminal groups gain recognition, wey fit attract support and funding.
"Bandits always want make dia names spread well well like international organisations wey dey sponsor terror. E go help dem get more money, get more encouragement, so dat dem fit kontinu dia day-to-day activities," Dandurimin Iya tok.
Di third reason na ransom. According to am, money wey dey come from ransom payments dey help sustain bandits operations and allow dem buy weapons and oda supplies.
E tok say "Dem dey usually use dat ransom money buy guns, take care of dia families, take care of dia day-to-day activities and even buy fuel and oda materials,".
Di fourth reason, e say, na to expose wetin dem see as weakness for di security system and bandits dey use mass kidnapping create fear among citizens and reduce public confidence for security agencies.
"To downgrade dia security managers so dat people go believe say security weak and no fit do anything to protect dem, make society fear bandits more."
On top how dem fit solve di wahala, Detective Auwalu call for adoption of wetin e describe as forest marshalling policy.
E explain say local vigilantes and community security personnel need to be engaged and trained to help fight criminal activities for forests and remote areas. According to am, di training suppose happun through different programmes wey go strengthen dia operational capacity.
"Govment gatz to adopt wetin we call forest marshalling policy in order to use our vigilantes, our security and local security, make dem engage dem and train dem,' e talk.
E also argue say once dem implement di policy, e no go put heavy financial burden on govment.
"When dis forest marshalling policy is implemented, no need dey for govment to spend dia money on di policy. Dem go generate money for dia selves bicos di activities go generate money for di policy" e tok.
Detective Dandurimin Iya also recommend make govment establish one Centre for Intelligent Research to study di root causes of kidnapping and insecurity.
E say di centre suppose bring togeda researchers from different backgrounds to examine di causes of kidnapping and develop practical solutions.























