Police arrest commissioner, 5 odas wey allegedly get hand for di beating of deputy director to death for Delta

Dr Unity Adeda with in academic gown
Published
Read am in 4 mins

Delta State Police Command don arrest di State Commissioner for Secondary Education, Dr. Kingsley Ashibogwu along wit three oda pesins.

Dis na ontop di investigation into di di death of Mr Unity Ekpevbughe Adeda, di Deputy Director for di Delta State Ministry of Secondary Education.

Police tok tok pesin, SP Bright Edafe for statement say wit dis, five pesins dey dia custody while dem don launch manhunt for two oda key suspects, Mrs Clemetine Ufuoma, Director of Basic and Secondary Education, and Clement Apia, driver to di Commissioner for Secondary Education, wey dem also need.

Di Commissioner of Police, Delta State Command, Samuel E. Erale, urge di two suspects, wia eva dem dey to make demsefs available to di Police witout further delay as dem go pursue di 'investigation thoroughly, impartially and professionally.'

E come assure di family of di deceased and members of di public say dem go follow due process and bring anybody wey get hand to justice according to di law.

How Dr Unity Adeda kpai?

Dr Unity Adeda with swollen eyes and wear white singlet
Wetin we call dis foto, Dr. Unity Adeda, deputy director for Delta State Ministry of Secondary Education allegedly kpai afta e receive beating for office

Dr Adeda allegedly kpai afta one incident for di Examination and Records Department of di Ministry of Secondary Education inside allegation say pipo wey dey linked to di Commissioner for Secondary Education na im beat am.

Dr Adeda later die afta dem rush am go hospital from di injuries wey e sustain as a result if di beating.

Sake of dis Labour Unions for Delta State both di Nigerian Labour Congress and di Trade Union Congress call strike action to protest di death of one of di civil servants, wey be dia members.

Chairman NLC Delta State, Goodluck Oforbruku note say di death of govment employee raise serious concerns about work place safety and accountability and dem condemn di incident wey happun.

"We get information say di Honorable commissioner for secondary education get altercation wit deputy director for Exams and Records and e order di man to leave but di man say e no go go becos dat na im place of primary assignment."

"So di Honorable Commissioner come invite im boys , presumably thugs, to beat am up, tie am and lock am somewia. Eventually wen dem release am dem rush am go hospital and e come kpai."

Delta State Govment set up panel to investigate di death of Dr Adeda

Labour call off di strike action afta di Delta State Govment set up a 8 man panel of inquiry headed by di Permanent secretary of di office of di Head of Service as well as di Labour leaders.

Di committee go look into di situation and bring report of wetin happun for di incident.

Meanwhile, di Adeda family dey demand justice for di death of Dr. Adeda as dem ask for thorough and impartial investigation into im death and ask di state govment to make sure say evri pesin wey get hand for di incident face di law.

Di Delta State Govment pay condolence visit to di widow of late Adeda.

Na di secretary to di Delta State Govment Kingsley Emu and oda Govment officials lead di delegation, e say dem dey mourn wit di family and di entire State and say dem go ensure say justice prevail for di mata.

Secretary to Delta State Govment Kingsley Emu with flora officials pay condolence visit to di widow of Dr. Adeda for dia house for Asaba di state capital